Omoyele Sowore shot: Police deny shooting Sowore for Abuja Unity Fountain

Date:

Nigerian activist, Omoyele Sowore post for im social media page allege say police shoot am for leg on Monday as im dey hold a protest.
Sowore wey dey ginger for Buhari Must Go protest, tweet say police officers shoot at am for Abuja Unity Fountain in di morning inside di kontri capital.
But di police say dem no get hand for Sowore shooting.
Police say di tori wey di waka say na female assistant of Police shoot am for Unity Fountain no be true.
Eyewitnesses say one police officer fire teargas at di gathering and di canister hit di publisher wey fall down on di spot.
Omoyele Sowore “Omoyele Sowore”: [Sowore shot]
WIA DIS FOTO COME FROM, TWITTER/@YELESOWORE
Wetin we call dis foto,
Omoyele Sowore , di 50 year old publisher of Sahara Reporters bin don dey ginger for one “#RevolutionNow” protest for Nigeria since August 2019.
Di 50 year old publisher of Sahara Reporters bin don dey ginger for one “#RevolutionNow” protest for Nigeria since August 2019.
Sowore allege say as im pipo dey try organise one protest waka on top security mata for di kontri. Before dem go know, dem hear gunshot, and then di bullet hit Sowore for leg.
Di tori be say, Sowore and oda protesters bin land di Unity Fountain in di morning wia dem go wait for di entrance.
For Twitter post Sowore show picture of im injury and also call on di struggle to continue even if dem kill am.
Omoyele Sowore “Omoyele Sowore”: [Sowore shot]
WIA DIS FOTO COME FROM, SAHARA REPORTERS
Abuja police tok tok pesin, Yusuf Mariam explain say di police professionally restore calm afta some group of protesters dey try incite public disturbance.
Police say di tori wey di waka say na female assistant of Police shoot am for Unity Fountain no be true.
She further explain say di protesters action fit cause di breakdown of law and order.
Di police tok tok pesin also urge Abuja pipo make dem liver no cut dem and make them remain calm.
Di command dey do everything possible te ensure the safety of dia lives and property, Yusuf Mariam add.
‘Sowore shot’ wetin hospital tok?
Afta di police hit di activist, dem rush am to Wellington hospital for Abuja.
At di time our reporter call di hospital to confirm weda dem bring Omoyele Sowore come dia, dem say yes.
But dem no tell weda na shoot- dem shoot am or weda na just injury e get.
Report wey reach BBC News Pidgin show say e don comot from di hospital.
Tori be say Sowore go like make im personal doctor attend to am.

Thank you for reading this post, don't forget to subscribe!
Naija247news
Naija247newshttps://www.naija247news.com/
Naija247news is an investigative news platform that tracks news on Nigerian Economy, Business, Politics, Financial and Africa and Global Economy.

Share post:

Subscribe

Popular

More like this
Related

Mbah inaugurates ESUT Governing Council

Governor of Enugu State, Dr. Peter Mbah has inaugurated...

Canada-based Nigerian playwright, Oguntokun is dead

Renowned Nigerian playwright and theatre director, Wole Oguntokun, is...

Atiku’s loyalists declare support for Tinubu, Fubara

By Daniel Abia, P/Harcourt Members of the former Rivers State...

FAAN shuts KFC outlet at MMIA

In response to a social media report by a...
Social Media Auto Publish Powered By : XYZScripts.com

Discover more from Naija247news

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading